Tuesday, 8 July 2014

E be like say no more blue for Mikel


E be like say our pesin Mikel Obi go begin dey find wia to tap ball nes seasin as hin club Chelsea don dey plan to offload de guyman.
De Blues don dey eye France midfielder Paul Pogba even as dia manaja Jose Mourinho don spend ogbonge £60 million buy Cesc Fabregas and Diego Costa.
Mourinho wan make Chelsea midfield solid like iron wey no fit bend as dem jus play anyhow las seasin and Mikel sef no come de find shirt again.
Na wen Nemanja Matic enta tins begin dey dey one kain for Mikel and now sef de wahala go boku as UK paper Standard don repot say Chelsea go offload am.
De Standard come add say Chelsea wan sell abi na offload some playas so kulele go dey to buy Pogba so dem dey wait for Mikel and Ramires maket.
Pogba agent, Mino Raiola don dey yarn dy relate tey tey say de midfielder no de go anywoa but de Italo Champions go fit tempt to sell am for beta pepper make dem sef enta maket.
Juventus fit tok say make any club wey wan carry am drop £60 million as Chelsea go dey luk bak becos Paris Saint Germain and Manchester City sef dey eye de foma Manchester United playa.
Na two years remain make Pogba kontrak wit Juventus kpai as de guyman shinew well well for France as dem comot for kwata-finals for dis World Cup wey dey shele...

No comments:

Post a Comment